Search

Chinese rocket falling to planet earth update: China rocket crash for Indian Ocean - Report - BBC News

"China rocket live tracking update": Chinese rocket crash for 'planet earth' Indian Ocean

Wia dis foto come from, STR

Chinese damaged rocket wey bin dey roll back to planet earth don land.

Di parts of di rocket crash scatter over di Indian Ocean, according to China state media

Di major part of di rocket destroy during di re-entry, Chinese goment tori pipo tok.

Parts di damaged rocket land for one location 72.47° East and 2.65° North, Chinese state-run media dey report.

"China rocket live tracking update": Chinese rocket crash for 'planet earth' Indian Ocean

Wia dis foto come from, Getty Images

Di point wia e fall dey around west of di Maldives.

But US Space Command say dem no dey sure of di exact area e land.

US and European tracking sites bin don dey monitor di uncontrolled fall of di Long March-5b vehicle.

Chinese state media say parts of di rocket re-enter di atmosphere at 10:24 Beijing time (02:24 GMT) on Sunday.

"China rocket live tracking update": Chinese rocket crash for 'planet earth' Indian Ocean

US Space Command tok for one statement say dem fit "confam say di Chinese Long March-5b re-enter over di Arabian Peninsula".

Dem no "sabi if di parts impact land or water," di agency tok.

Ahead of di rocket re-entry dem bin get fears say di damaged rocket fit come down for one area wia pipo no dey live.

US Defence Secretary Lloyd Austin say China dey negligent to let di rocket fall out of orbit.

However, space experts don predict say di chances of anyone actually being hit by one piece of space junk dey very small.

Not least because so much of di Earth surface dey covered by ocean, and pipo no dye live for huge land areas. Di experts tok.

"China rocket live tracking update": Chinese rocket crash for 'planet earth' Indian Ocean
"China rocket live tracking update": Chinese rocket crash for 'planet earth' Indian Ocean

Dem use di main segment from di Long March-5b vehicle to launch di first module of China new space station last month.

At 18 tonnes, e be one of di largest items for decades to have undirected dive into di atmosphere.

Di US tok last week say dem bin dey watch di path of di object - but dem no get plans to shoot am down.

Adblock test (Why?)


https://www.bbc.com/pidgin/tori-57045480

2021-05-09 07:52:30Z
CBMiKGh0dHBzOi8vd3d3LmJiYy5jb20vcGlkZ2luL3RvcmktNTcwNDU0ODDSASxodHRwczovL3d3dy5iYmMuY29tL3BpZGdpbi90b3JpLTU3MDQ1NDgwLmFtcA

Bagikan Berita Ini

0 Response to "Chinese rocket falling to planet earth update: China rocket crash for Indian Ocean - Report - BBC News"

Post a Comment

Powered by Blogger.